ADANNA Season 2 Episode 1

0
550

Sister B: Ozes you don ready finish!

Me: e remain small oh, time don reach?

Sister B: e remain ten minutes oh, quick abeg or else you go miss direct motor oh.

Me: okay ma.

Oh yes I just finish my 1 year IT and it’s time for me to return to school, I don spend one month for my elder sister house time don reach for me to go meet my mates for school, them don resume Tey Tey but the sweet EBA and black soup wey my sister dey cook too sweet for me to leave am, infact as I dey go so I carry full bag of garri, even my sister say make I leave am say I go buy garri there I disagree because once i reach there many things dey wey I go buy, so many many things that I can’t even count though I wrote them down.

I arrange my files finish for my bag and pocket my phone, I put my hang bag on my back and carry my ecolac bag for my right hand.

Me: sister I don do finish.

Sister B: na how you wan come take carry this bag of garri?

Me: I go use wheel Barrow.

Sister B: who go come carry the ecolac bag?

Me: you, “I said grinning”

Sister B: you nor well.

Me: no worry make I carry the ecolac go park first with wheelbarrow I go come back come carry the ecolac bag.

Sister B: yeye boy, give me the ecolac bag joor. she carry the ecolac bag from my hand while I enter back go carry wheel barrow, I carried the bag of garrison outside and put am inside the wheelbarrow, my sister locked the door and begin draw the ecolac bag they go while I dey follow her for yash with my wheelbarrow sweating like mumu, una go dey ask why I dey sweat? well the place I dey carry the wheelbarrow pass na heavy hill so una go understand.

We reached the park come see sweat for my body like say I just finish play 2 hours ball for Emirate stadium, we reach Afuze park by 6Am three motors don move already and the fourth wey wan commot don full already that means I go be first person for the fifth motor chai see badluck, as badluck don start with me this morning I hope no be badluck go follow me reach aba town, I rebuke badluck in Jesus Name Amen.

I carry my big garrI bag put for boot and bade my sister goodbye, she don give me money already so I nor expect anything from her again, she carry the wheelbarrow and started going home after telling me ten times that I should not kill my battery with games, of course she know say I be game freak and once I don enter bus to portharcourt na to start game sharperly.

I sat at the front of the station wagon motor (oh yes this one no be car na motor) I plug in my ear phone and begin to listen to one latest mixtape wey I download from pobsonline, the song were so interesting that I didn’t know when our motor full, oh yeah I forget I never pay for my ticket I quickly dash out after putting my bag in my seat so that nobody will sit there, I go meet the yeye girl wey dey give ticket and guess the number wey she give me, number 8 the last person.

Me: wetin bring this one na, no be me be first person?

Girl: I nor see.

Me: idiot.

Girl: mumu.

I go back to the motor the yeye girl wey get number one don even remove my bag put for back, I nor blame her joor and I nor get anoda choice so I jejely enter the back sit wey they tight like say na prisoner we be, well thank God say Auchi no far from here within 20 minutes we don reach.

As everybody don enter finish the driver started the motor as we drive commot from Afuze town, na Auchi I go follow go portharcourt, then from port to Aba city where my school day, I prayed for safe journey mercy oh, as I put my ear phone for my ear and begin listen to one song wey them title ” f**k me hard”